It's Paul Olarewaju's Blog: Today na Today for France (Naija style)

Instagram

Monday, 30 June 2014

Today na Today for France (Naija style)

Today na de day wey everybody for Africa dey wait for as Naija wey na dem be de Baba for Africa go enta de same trouser with France for dia lass 16 katakata for de 2014 Fifa World Cup. Na 5 African countri dem na hin enta Brazil for dis year World Cup, but na only Naija and Algeria fit make am enta de lass 16.

Since de time wey Naija don dey tap ball for de World Cup, walahi de Supa Eagus neva for dia life fly pass de lass 16, and all dia fans don dey pray say make dem bilala France today.

De koko for de matta wey dey ground now be say de match go tough die for Naija becos na France carry fess for dia Group, and na plenty goals sef na hin dem take kwalify. Naija and France don jam diasef bifor bifor for one play play match wey shelle for de year 2009, and na Naija win de match as dem waya France 1 kondo. Joseph Akpala na hin be de Supa Eagus playa wey score de goal wey helep Naija win de match dat time.

Meanwilly, Naija coachi, Stephen Keshi kon yarn we amebo for supersport.com say im and hin boys don sit down jeje do family meeting, and na muss make hin boys bilala France today. “I don tok am bifor say na step by step na hin be our parole for dis World Cup becos I no wan make we fall our hand for Brazil, but France no go believe how my boys go take wicked dem for our ness game,” naso Oga Keshi yarn.

Na 5pm Naija time na hin de match go take start for Brazil, and make unna no forget to join us for our live tori as we go pack everything come unna door mouth. Abeg na who unna think sef say go win dis match between Naija and France? Oya make unna dey tok make we hear.

Source: supersport

No comments:

Post a Comment

BE THE FIRST TO COMMENT

Your opinion counts, kindly ensure you drop your comment(s) each time you visit.

Comments on this blog are free opinions of readers, as such Paul will not be liable for them.